Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

2019 AFCON draw na today

As count down continue for the Afcon draws wey go shele for Cairo Egypt, Teams don begin dey think who dem fit jam or avoid.

CAF don divide the 24 teams according to the latest Fifa rankings wey dey on ground and for Bafana Bafana wey dey pot 3 with Uganda, Benin, Mauritania, Madagascar and Kenya and dem fit jam tough draw for the 2019 Africa Cup of Nations after dem allot pots on Thursday.
The seedings see heavyweight countries like Egypt wey be host, defending champion wey be Cameroon, Senegal, Tunisia, Nigeria and Morocco for inside Pot 1.
For Pot 2 na DR Congo, Ghana, Mali, Ivory Coast, Guinea and Algeria dey there.The countries wey their ranking no reach that is wey dey low dey for inside Pot 4 – Zimbabwe, Namibia, Guinea-Bissau, Angola, Tanzania and Burundi.
As e dey so many countries go dey pray to avoid some kine teams like Nigeria or even Egypt for group so as to avoid to go house quick.
Namibia coachee wey be Ricardo Manetti don tok say im wan avoid the Egyptian team say e go hard wella to play against the Pharaohs in front of their people.
Like say that one never do, Kenya coachee wey be  Sebastien Minier come add join say dem get something to prove and so say dem qualify show say dem deserve to play for the Afcons.
Madagascar coachee wey be Nicolas Dupuis say Egypt na home o but say senegal dey there o and for him o Senegal na the best team for Africa now.
E say Cote d’Ivoire impresse am not forgetting Morocco or Nigeria.Dis one go be the first Afcon for Madagascar and dem go like go far but with all the big big teams wey dey dem know say na big task dey face dem .

 

Dis na the Seedings For Afcon Draw wey go shele on Friday 12th of April
Pot 1: Egypt, Cameroon, Senegal, Tunisia, Nigeria, Morocco
Pot 2: DR Congo, Ghana, Mali, Ivory Coast, Guinea, Algeria
Pot 3: South Africa, Uganda, Benin, Mauritania, Madagascar, Kenya
Pot 4: Zimbabwe, Namibia, Guinea-Bissau, Angola, Tanzania, Burundi

The post 2019 AFCON draw na today appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Simon sets new personal best in Europe top five league

Philomina Ngozi

Morocco, Egypt emerge champions of Africa Beach Volleyball Cup

Philomina Ngozi

Rangers want to win Aiteo cup final for Governor Ugwuanyi, Says Itoya

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy