Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Africa Beach soccer games 2019 go hold for Cape Verde

Tori say the African Beach Games 2019 wey go shele for Cape Verde for June go see the first ever African Beach Games happen for the island of Sal. 

The event go see different beach soccer teams wey dey across Africa do serious battle to take qualify to the ANOC World Beach Games 2019 wey go hold for inside  San Diego, California join one group of four women’s teams dem.

 

Na 19th go reach 23rd 2019 be the dates wey dey don confirm for the event.

 

Na only  two available places dey for the men for the ANOC World Beach Games 2019, while for the women na only the winner of the group go qualify.

 

The men go play their own  competition  over all five days wey consist of three days of round robin, follow by the semi-finals then the final go come shele .

 

E Dey likely say dem go play the tournament between 12 teams wey dem go divide into three groups, already 11 don dey sure.

 

Dem don plan the women competition  into three days of round robin system, and but dem never confirm the four teams wey go take part.

 

Na the Association of National Olympic Committees of Africa (ANOCA) organize dis one so.

 

Dis na the participating teams for the  men’s competition wey dem dey sure of say go participate :

 

Cape Verde

Morocco

Cote d´Ivoire

Egypt

Ghana

Kenya

Libya

Djibouti

Nigeria

Senegal

Uganda

The post Africa Beach soccer games 2019 go hold for Cape Verde appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

True Story Of How The Son Of DSS Boss Abba Bichi Made Nigeria U17 World Cup Squad

Philomina Ngozi

Everton Sack Silva After Merseyside Derby Defeat To Liverpool

Philomina Ngozi

Chiejine lauds Falconets’ effort despite World Cup ouster

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy