Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Algeria drop Midfielder sake of say e expose im bumbum

Algeria coach Djamel Belmadi don provoke drop midfielder Haris Belkebla from the country African Cup of Nations squad after e expose im bum bum for one live stream wey dem do.

The Video footage of Belkebla dey circulate for social media and e show where e expose im backside.

 

Dis one wey shele so provoke Algeria coachee wey be Djamel Belmadi drop the midfielder from the squad and now dem dey expect USM Alger midfielder Mohamed Benkhemassa to replace am.

 

Meanwhile, Belkabla don come out to apologise give im team-mates and the Algerian people as the team preparations for the African Cup of Nations continue.

 

The 25-year-old midfielder never play for Algeria senior side but e don play for their U-23 side.

 

Belkebla don make 36 appearances in all for Brest dis season for France Ligue 2 as the club bin finish second to kolobi promotion enter Ligue 1.

 

Algeria dey Group C with Senegal, Kenya and Tanzania. Algeria go start their waka for Egypt on June 23 against Kenya before dem go come jam Senegal four days later.

 

Dem go gbege Tanzania for their last group game on July 1.

The post Algeria drop Midfielder sake of say e expose im bumbum appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Omeruo Impresses Against Messi, but Barcelona Grind Out Victory Over Leganes

Philomina Ngozi

Osimhen Waiting On Offer From Chelsea Before Deciding On Manchester United

Philomina Ngozi

Aftermath of U-17 AFCON: Eaglets reject NFF’s N40K transport fare

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy