Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

All eyes dey ontop 2019 AFCON prize money

Tori say every qualified team for this year AFCON tournament go kolobi at least $600,000 each go house for participation.

According to CAF Presido wey be Ahmad Ahmad, the winner go kolobi $4.5m join the trophy wey dem go win come July 19.As e dey so CAF don increase the team wey dey participate from 16 go 24 so, therefore, dem don increase prize money too.

 

Aproko say the Black Stars of Ghana dey flex muscles to kolobi $4.5 million if dem fit kpake their fifth Africa Cup of Nations for Egypt this year.

 

The Stars dey Group F together with 2017 AFCON champions, Cameroon, Benin and Guinea Bissau.

 

Current AFCON champions wey be Cameroon bin kpake $4m go house wen dem win the tournament for 2017 while runners-up Egypt, collect $2m.

 

Third-placed and fourth-placed nations wey be Burkina Faso and Ghana collect $1.5m each go. So den gbegerism go start by June teams go make sure say dey follow share something sha.

The post All eyes dey ontop 2019 AFCON prize money appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Osarenoma excited with Falcons recall, praises “Teacher” Dennerby

Philomina Ngozi

Granada Defender Duarte Hails Exceptional ‘Talent’ Ramon Azeez

Philomina Ngozi

Naby Keita Trains Harder, Eager To Boost Guinea’s Starting-11 Against Super Eagles

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy