Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Ancelotti wan kpake James

Napoli head coachee wey be Carlo Ancelotti get hope say James Rodriguez go sign for the Series A club dis summer.

James don come out as transfer target for the club wey the man wey kolobi am from Monaco and  the b4 b4 Real Madrid and Bayern Munich Oga wey be Ancelotti say e want the Colombian.

 

The Italian coachila bin kpake James from AS Monaco web im  bin dey in charge for the Santiago Bernabeu for 2014, after e ginger well for the 2014 World Cup finals for inside Brazil.

 

The 27-year-old future no clear as e no dey Oga Zinedine Zidane  new plan and Bundesliga  champions Bayern Munich Don make up their mind say dey no go permanent im loan Waka even after e spend two-years on top loan Waka with den from Madrid.

 

Tori say Napoli get interest to kolobi James ontop loan deal although Madrid wan sell am Kpata Kpata for €42 million ($47m, £38m) as dem  dey look to raise more kpogiri for the busy transfer window.

 

Even though say na Napoli be  favourites to sign James, April say  Atletico Madrid dey monitor situation like monitoring Lizard.

The post Ancelotti wan kpake James appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Eagles won’t underrate Bafana Bafana – Moses

Philomina Ngozi

Iheanacho Delighted With Pre-Season Campaign

Philomina Ngozi

U-17 W/Cup Qualifier: Flamingos Outclass Guinea; To Face Ghana In Play-off 

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy