Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Black Goalkeepers must to work harder, says Ajax No. 1 Onana

Cameroon goalkeeper and Ajax Amsterdam goalkeeper wey be Andre Onana tok say for black goalkeepers to make am for the top of European football, dem must dey ready to work harder wella.

Onana just dey shine for Ajax since im waka come the club for 2015 and im  ginger don pay as e kolobi the Dutch cup with dem.
Since im waka come the Dutch Club, e dey hope, dey pray to become the first black goalkeeper to play for Europe top competition since 2017.
Onana dey also hope say dis one go dey possible if Ajax fit finally kolobi their ticket enter the Final of the Champions League wen dem jam Tottenham for the second leg on Wednesday.
As e dey so Many top clubs for Europe don shok eyes put for Onana and some of im teammates dem after their ogbonge performance for Ajax so far for the UCL and so their names don link with waka comot from the Dutch side.
Onana sef don tok im mind say im  go  like waka  go back Spain where im oyibo career bin start with Barcelona wen e dey 13 years old.
People dey expect make Onana play better role for Cameroon for the 2019 Africa Cup of Nations for inside Egypt.
The Indomitable Lions dey the same group F  with Benin, Ghana and Guinea-Bissau.

The post Black Goalkeepers must to work harder, says Ajax No. 1 Onana appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Akwa United record biggest win of the season

I’m A Big Goalkeeper With No Supporter, Says Akpeyi

Philomina Ngozi

Onuachu ‘Very Happy’ To End 3-Game Goal Drought For FC Midtjylland

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy