Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Coachee Whyte Ogbonda dey tok tough as im team ready for Abia Angels

Confluence Queens head coach, ee wey be Whyte Ogbonda don predict say na done and dusted  kasala e be for im side against visitors Abia Angels.

The Lokoja team go welcome the Umuahia side for Wednesday Nigeria Women Premier League (NWPL) matchday 3 kasala for the Lokoja Township Stadium.

 

The Lokoja side bin share the spoils Gboko  for with hosts and newcomers, Invincible Angels for the  NWPL matchday 2 gbege when e end for 1-1 draw.

 

Abia Angels on the other hand chop am 2-0 kondo for the hand of Ibom Angels  for inside Uyo to carry pave way for the week 3 matchup.

 

Ogbonda tok say im side dey ginger and say dem ready  for their first-ever NWPL Super 4 action as well as the podium dance for the end of the on-going top-flight.

 

E say dem dey target nothing less than  four, five unreplied goals for the kasala but that one no means say dem dey  disrespect their visitors wey be  Abia Angels.

Confluence Queens dey top of the four-team NWPL Group D log ontop four points , one ahead of closest challengers Ibom Angels.

The post Coachee Whyte Ogbonda dey tok tough as im team ready for Abia Angels appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Falcons get fitness trainer and match reader

Philomina Ngozi

Aigbogun calm over 2019 FIFA U20 world cup draw

There’s Always A Place For A Good Player – Rohr On Chidera Ejuke

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy