Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Dem don suspend La liga indefinitely

Tori say dem don suspend the LaLiga and the rest of the Spanish football calendar until further notice as the coronavirus don continue to scatter sport across the world.

LaLiga and the Spanish soccer federation (RFEF) yarn the news for inside joint statement wey dem bin release today.

 

 

Dem bin postpone All organised football for inside Spain for two weeks’ sake of the coronavirus, the league suppose resume on April 3 but that one now don change as football for inside Spain no go start any time soon.

 

The statement wey the two join bodies bin release together tok say dem don gree to postpone all professional soccer competitions until the Spanish government feel say dem fit start again if health risk no dey.

 

RFEF chief wey be Luis Rubiales don last week say e no go cancel the current season as e insist say the campaign fit re-start once the health crisis dey under control.

The post Dem don suspend La liga indefinitely appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Video Assistant Referee (VAR): Good or bad for Football?

Philomina Ngozi

Confluence Queens coach White celebrate Super 4 ticket

Philomina Ngozi

Monte-Carlo Masters: I played one of my worst matches on clay – Nadal

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy