Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Dosu Joseph: Na Striking Position hot pass for world now

Olympic ’96 Gold Medalist for football and b4.naija international Goalkeeper Dosu Joseph tok say na striking position naim players scare pass for world.

E yarn dis one when e bin answer question concerning which position market dey sell wella pass. Dosu say as e dey for world now, strikers na hot cake and if dem hear say one striker dey for somewhere dey score plenty goals , dem go sharperly go look for am to kolobi am.

According to am e say for all the department for football, e say to get strikers naim hard pass any other position for world of football.

 

Unto wetin dey make am hard for strikers to score nowadays, e say the technic of the game wey done improve wella follow dey make am difficult for strikers to score.

 

E say teams wan play ten men behind with goalkeeper making 11. E come encourage the Naija players to begin  ginger wella as Naija people dey their back.

The post Dosu Joseph: Na Striking Position hot pass for world now appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Rohr Visits Sports Minister Dare In Abuja, Commended For Eagles Job

Philomina Ngozi

National Youth Games: Team Delta on course to reclaim overall winner’s title

Philomina Ngozi

Sports Minister Happy With Return of NBBF Premier League

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy