Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Make una plan for future oooo – Ibom Angels coach tells Dennerby

Morufu Adeyemo wey be the coachila of Ibom Angels Football Club tok say e go make sense to pick cha-cha set of future Super Falcons from the current home base Super Falcons wey dey represent for the WAFU tournament wey dey shele for inside Cote d’ Ivoire so. Coach Adeyemo advise Super Falcons handlers say make dem make good use of dis opportunity wey dey shele for inside Cote d’Ivoire to carry select new set of Falcons as e point out say many of dem wey dey go dis World cup for France so  fit no represent the country again for the next edition, so e go good to build up another crop of players to avoid story wey dey touch the heart.

 

Adeyemo come hail Glory Ogbonna wey be the ony player from the club wey dey represent for the Women senior National team.

 

E salute her hard work  and the way she carry dey dedicated for wetin she dey do and e don carry the same advise samma other Ibom Angels players say make dem follow Glory example if dem wan make am entering any of the national teams dem.

 

Meanwhile, the club don appoint monitoring committee to shok eye put for  players welfare, discipline and other social challenges join.

 

Na Ukeme Okon wey be the skippo of the club and other selected players na dem dey the Committee.

The post Make una plan for future oooo – Ibom Angels coach tells Dennerby appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

2021 AFCONQ: Ezenwa declares readiness for Sierra Leone clash

Philomina Ngozi

Sanusi hails, charges Lobi Stars, Rangers International

Take advantage of the opportunities offered by 1xBet

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy