Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Muller don sign chacha deal for Bayern

Germany player wey be Thomas Muller don sign one chacha three-year contract wey go make am put mat for ground stay for Bayern Munich.

This one sef don finally ends the aproko wey dey say e wan waka leave the club.

 

Muller don dey the Bundesliga giants since 2008 and now e don carry pen put onto paper to take sign new deal go reach June 2023.

 

The 30-year-old bin respect himself, keep social distance to take some kine photo dem to take announce the deal on Tuesday.

 

Muller come pose with one Bayern Munich shirt together with the club sporting director wey be Hasan Salihamidzic and executive board member wey be Oliver Khan.

 

The three of dem make sure say dem maintain their distance sake of the coronavirus pandemic wey dey on the ground.

 

The forward bin dey think im future before the club sack Niko Kovacfor November. Muller no too get chance to play under the b4 Bayern oga and e bin dey consider to waka as e dey enter the final year of him deal.

The post Muller don sign chacha deal for Bayern appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

It’s Nigeria vs Riyad Mahrez again! Super Eagles get Algeria in AFCON semi-final

Philomina Ngozi

Ronaldo Fined €18.8m, Plus 23-Month Prison Sentence For Tax Evasion

Rotherham Coach, Warne: Nigeria Call-up Has Boosted Ajayi’s Confidence

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy