Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Na 7 Naija Referees for FIFA course

Federation of International Football Association, FIFA, don list seven Nigerian referees for different categories of their Futuro 111 Course for referees instructors wey go shele for inside Kigali Rwanda, later dis month.

Other referees wey come from other African countries go also follow take part for the exercise. Ago Abubakar and Ugheli Cecilia go take part for the Technical category while retired 5-A-Side FIFA referee wey be Ibrahim Fagge go for the Fitness category.

Those wey dem list for the Advanced Category of the annual course include international referee instructor Callistus Chukwujekwu, Peter Edibe, Felicia Okwugba and Engr Emmanuel Imiere (FIFA rtd).

The Nigeria Referees Association (NRA) Presido wey be Otunba Tade Azeez don thank the Nigeria Football Federation (NFF) for their support to dey train and retrain referees for maximum performance ontop domestic and international waka dem.

The post Na 7 Naija Referees for FIFA course appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Iwobi Subbed Off As Rampant Arsenal Gun Spurs Down In Thrilling Derby

Madagascar Coach Nicolas Dupuis gets his Wish with Super Eagles draw

Philomina Ngozi

Abdullahi Calls For Unity In The Fight Against Coronavirus

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy