Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Na Naija go host Africa Volleyball Zone 3 clubs Championship

Tori say everything don dey set to host the second edition of the Confederation of Africa Volleyball (CAVB) Zone 3 male and female clubs championships wey dem don put down say go hold for  Lagos between 14th and 19th April 2019.

Dem say na Twenty-two male and female clubs from six countries go follow participate for the tournament wey the host wey be  Naija go present the highest numbers of clubs.

The list of clubs wey don register show say the Benin Republic go present two male clubs, Finances, Entente and Entente for the female category. Burkina Faso get Sonapost for male and As Douanes for the female categories.

 

Ghana sef no carry last as dem go present their best clubs, Ghana police for the two categories while Niger get Gendarmerie and Police for the two categories.

 

Togo register two male clubs wey be AS OTR and Etoile Filante while the female club na AS OTR.

 

The host, Naija go present the highest number of clubs for both the male and female categories. Naija go present Nigeria Immigration, Nigeria Customs, Nigeria Civil Defence and Kano Pillars for the male category while Nigeria Customs, Nigeria Immigration, Nigeria Civil Defence, Kada Emeralds and Benue Queens go show for the female category.

Presido of the Nigeria Volleyball Federation wey be Engineer Musa Nimrod tok say dem don conclude all the arrangements to take make sure say everything wey concern hosting of big tournament like this one go well as dem no want wetin happen before to repeat.

 

Gist say the organizing and technical committee pipu of the federation don already inspect facilities and other tins for the University of Lagos.

Dem dey expect the clubs to begin enter obodo Nigeria from the 13th of April,2019.

The post Na Naija go host Africa Volleyball Zone 3 clubs Championship appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Manchester United rejects Inter Milan’s bid for Lukaku

Philomina Ngozi

Liverpool’s Sheyi Ojo ready to dump England for Nigeria

Manu Garba Confident Of Eaglets Victory Against Niger

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy