Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Na Neymar dey collect pass for Ligue 1

Neymar dey way ahead of  Kylian Mbappe and im other team mates dem for the waka to be Ligue 1 richest asset, as Paris Saint-Germain dey boast clean sweep of the top 11 highest-paid players for inside  France.

Tori from inside France  don use style release the total monthly salaries  wey dey across the country top tier.Brazil starboy wey be  Neymar, wey bin join PSG from Barcelona for £198million for August 2017 na im still be  the division’ top earner  as im dey  kolobi around £2.6million  every month even  before  e pay tax.

 

That one is equal to weekly salary of around £600,000.

 

Players wey dey give am close marking na im team-mate Mbappe wey dey collect reach  around £375,000 every week.Bonuses no dey for all dis kpogiri  wey dem dey collect so.

 

PSG  presently dey top  the ligue 1 with 12 points and their financial seniority  show say  the top 11 richest players wey dey inside the division dey for Thomas Tuchel squad.

 

Edison Cavani, Marquinhos, Thiago Silva, Marco Verratti, Angel Di Maria and Keylor Navas dey kolobi at least €1m a month. Monaco Wissam Ben Yedder  dey kpake (£127,000 a week) the richest of the rest.

The post Na Neymar dey collect pass for Ligue 1 appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Mikel not ruling out possible move to the Egyptian Premier league

Philomina Ngozi

Aigbogun: Flying Eagles Can’t Afford To Fail At 2019 U-20 AFCON

Sane Bags Winner As Man City Ends Liverpool Unbeaten Run In EPL

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy