Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Na Oparanozie go lead 27 other Falcons stars enter World Cup camp

Na Cecilia Nku, Ngozi Okobi and Captain Desire Oparanozie top the list of 27 players wey Naija Super Falcons Head Coachila Thomas Dennerby bin list  for the final camp for inside Austria as preparation go continue for the 8th FIFA Women’s World Cup finals wey go shele for inside France from 7th June go reach 7th July 2019.
Other players wey bin contribute to the Falcons Waka for Awcon for Ghana last year like Goalkeeper Tochukwu Oluehi, defenders Josephine Chukwunonye, Osinachi Ohale and Ngozi Ebere, midfielders Rita Chikwelu, Halimatu Ayinde and forwards Asisat Oshoala and Francisca Ordega follow dey the list.

 

Dennerby come still pick Uchenna Kanu, wey dey ginger her swagger for the WAFU Women’s Cup for Abidjan with eight goals for the two matches wey Super falcons don play so far. Other home-based professionals wey Dennerby pick na Amarachi Okoronkwo, Evelyn Nwabuoku, Chidinma Okeke and Chiamaka Nnadozie.

 

Naija final list of 23 players wey go Waka enter France for the 8th FIFA Women’s World Cup finals go come out from this group of 27. Dennerby go, comot four players, when the two-week camping for inside  Austria go end.

Ruth David wey be NFF Head of Women Football tok say the African champions go depart from Abuja go Austria on Monday, 20th May for the Avita Resort for Bad Tatzmannsdorf – the same facility where the Super Eagles bin hole their final camping program before the 2018 FIFA World Cup for Russia.

 

From there,  the Super Falcons go come go straight to Reims on June 4 , where den go open their World Cup campaign against Norway on 8th June.

Dis na the 27 Super Falcons players wey go enter camp for the final World Cup preparation.

 

Goalkeepers: Tochukwu Oluehi (Rivers Angels); Alaba Jonathan (Bayelsa Queens); Chiamaka Nnadozie (Rivers Angels); Christy Ohiaeriaku (Confluence Queens)

 

Defenders: Osinachi Ohale (Vaxjo DFF, Sweden); Ngozi Ebere (Arna Bjornar, Norway); Onome Ebi (Henan Huisanhang, China); Josephine Chukwunonye (Kungsbacka DFF, Sweden); Faith Michael (Pitea IF, Sweden); Chidinma Okeke (FC Robo)

 

Midfielders: Cecilia Nku (Ferencvaros Torna, Hungary); Rita Chikwelu (Krstianstand DFF, Sweden); Ngozi Okobi-Okeoghene (Eskiltuna United, Sweden); Evelyn Nwabuoku (Rivers Angels); Ogonna Chukwudi (Djurgardens IF, Sweden); Halimatu Ayinde (Eskiltuna United, Sweden); Amarachi Okoronkwo (Nasarawa Amazons)

 

Forwards: Desire Oparanozie (En Avant Guingamp, France); Anam Imo (Malmo FC Rosengard, Sweden); Asisat Oshoala (FC Barcelona, Spain); Chinaza Uchendu (SC Braga, Portugal); Uchenna Kanu (Southeastern University, USA); Rasheedat Ajibade (Alvadsnes IL, Norway); Francisca Ordega (Shanghai W. FC); Ini-Abasi Umotong (Brighton Hove & Albion, England); Alice Ogebe (Rivers Angels

The post Na Oparanozie go lead 27 other Falcons stars enter World Cup camp appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Best Player Bolton Signed! Former Trotters Captain compares Okocha to Ronaldinho

Philomina Ngozi

What Rivalry! Flying Eagles goalie writes off South Africa

Pinnick Vows Make Positive Reforms In 2nd Tenure As NFF President

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy