Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Naija team to leave their mark for the FIVB beach volleyball world tour for Qatar – Coach Imoudu

The Naija male beach volleyball team go follow participate for the FIVB beach volleyball world tour wey go hold for inside  Qatar between 12th-15th March 2019.

Na Team Naija be the only team from Africa wey go join other 36 countries for the main draw & 13 countries for the qualification draw for the four day beach volleyball tournament.

Na through wild card in preparations for ANOC Games in America this year team Nigeria bin make the Qatar male four star international beach volleyball tour.

The presido of the Nigeria Volleyball federation wey also be  the chairmo of beach volleyball commission, Engineer Musa Nimrod  don charge the team say make dem go make  Naija and the continent of Africa  proud and happy by proofing say  their ranking for the continent as one of the best.

Meanwhile the coachee of the team wey be Francis Imoudu yarn say even though dis one go be  Nigeria first time to participate for any FIVB beach tour, e  promise say dem go make sure say dem leave their mark for the  tournament.

According to Coach Imoudu “This go be the first time & na we go be the  only African team for inside entry wey reach  over forty countries. Dis na better  privilege for the boys to show wetin dem fit do”.

The post Naija team to leave their mark for the FIVB beach volleyball world tour for Qatar – Coach Imoudu appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

I fit kpokpo the top Three

Philomina Ngozi

Sell Ozil, kpake Ziyech for half price – Overmars

Philomina Ngozi

Eguavoen Begs Federal Government To Redeem House Pledge To 1994 AFCON – Winning Eagles

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy