Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

NNL take action ontop gbege between Malumfashi FC vs Kada City FC

After  dem don sidon shok eyes  think am well well concerning the official report of the rescheduled match wey dem play for inside Katsina,the NNL don make up their minds decide some things in line with vital sections of the rule book ontop assaults, encroachment, match disruption among others dem:

First  of all Dem decide say Malumfashi FC of Katsina go play their next three home games under doors wey dey locked tight.

 

Dem come give Club Presido wey be Alhaji Sirajo Baba 3 days from the day wey dem serve am letter to sharperly return  back all the bags and things wey e seize from match officials dem wey still dey im hand or else e go face serious sanctions.  Dem  give am dis order sake of the role wey e play to scatter the match.

Tori say Malumfashi FC get seven days to arrest and provide their club officials and supporters wey get hand for the assault against the match officials dem.

Finally,  dem come award the whole 3 points and 3 goals give Kada City of Kaduna.

 

Dis one go serve as better lessons for fans,  players or club officials wey want do anyhow cos dem go surely see anyhow.  The NNL say dey no go tolorate dis kine thing at all as e dey give league bad name.

The post NNL take action ontop gbege between Malumfashi FC vs Kada City FC appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

KRC Genk’s league position excites Dessers

Philomina Ngozi

Dalung hails Musa Kida led Nigeria Basketball Federation

Philomina Ngozi

Adepoju urge Super Eagles to beat Seychelles and Egypt for AFCON draws seeding

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy