Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Nobody touch me – Referee Maguette Ndiaye

Senegal Referee wey be Maguette Ndiaye wey dey middle for the Car confederations cup semi-final second leg Kasala between CS Sfaxien and Red Berkane don come out to you say no player/s attack am after the gbegerism finish for Morocco for weekend.

Tori wey dey say visiting players,  fans and officials den bin para, provoke come attack the officials with wetin resemble bottles and other objects den after Berkane overturn a 2-0 kondo first-leg deficit to kolobi the kasala 3-0 kondo.

 

But the ref wey the matter concern don carry two hands up say no be im dey the video wey show say dey Sfaxien players dey hassle am , e say na im second assistant dem bin attack.

 

Aproko wey dey say CAF don shok their gbejero eyes put to know wetin happen gangan after the video dey show everywhere say one Ref Don collect one blow two Akpu.

 

Na goals wey striker Kodjo Fo-Doh Laba, Omar Nemssaoui and Issoufou Dayo bin score for the first half helep the team from Morocco stroll enter the final, where den go jam head with SC Zamalek of Egypt.

 

Dem go play the First leg on May 19 for Berkane, while the second leg go shele for inside Alexandria seven days after.

The post Nobody touch me – Referee Maguette Ndiaye appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

AFCON 2019 Round Of 16 Fixtures And Kick-Off Time

Philomina Ngozi

Five Reasons Why Heerenveen Ace Chidera Ejuke Made Shock Move To CSKA Moscow

Philomina Ngozi

Laliga Boss Tebas Excited As Spanish Govt. Approves Season Restart In June

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy