Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

NPFL go observe 60 seconds silence, wear Black armband on MatchDay 22

Tori say Nigeria Professional Football League (NPFL) Coaches, Players and Officials dem go honour late Coachila Solomon Ogbeide. All of dem go wear black armbands come too observe one-minute silence during Match Day 22 fixtures wey go shele on Sunday, May 26.

Na Shehu Dikko wey be the Chairmo of the League Management Company (LMC) announce dis decision so.

 

E say  Wetin shele to the Lobi Stars Coach na big  loss to the league and hundreds of players wey e don train and work with over twenty years of im career as football coachee for the naija league.

Dikko come add join say the LMC go make sure say dem try wella to honour those wey in one way or the other contribute no matter how small and for which capacity to helep the development of we league.

Na the late Coachee carry Lobi Stars reach the group stage of dis year CAF Champions League. E join the club for 2017 and before that time e don coach Julius Berger, Warri Wolves and Sunshine Stars among others dem.

Ogbeide bin slump come kpuff  on Monday small time after e complain say im no feel well hours before their last home gbege of the season.

The post NPFL go observe 60 seconds silence, wear Black armband on MatchDay 22 appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Guardiola: Man City Not Ready To Win Champions League

Chukwu: No Cause For Alarm, Super Eagles Will Be Ready For World Cup

Philomina Ngozi

Super Eagles midfielder explains reason for dumping Algerian side

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy