Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Olayinka fit miss 2nd leg waka against Chelsea for europa League

Naija international wey be Peter Olayinka fit miss Slavia Prague waka go London next week for the second leg of their Europa League quarter final kasala with Chelsea sake of say yellow card matter.

As e dey so the striker dey play safe to take avoid to collect im number 3 yellow card for the competition wey fit see am go suspension.
Na against Bordeaux e first collect im first yellow for the Europa League, then e come collect another one eleven minutes after dem introductory am for the gbege against Sevilla last month.
According to wetin UEFA yarn ‘all yellow cards dey expire after dem finish the quarter-finals and dem no dey carry am over enter the semi-finals.
The Naija international get hand for Slavia Prague last seven kasalas for the Europa League. E don appear five times from the bench.
Na for 21 July 2018, Slavia Prague bin kolobi Olayinka ontop four-year contract from KAA Gent for kpogiri wey reach €3,200,000.
Tori say Olayinka fit be the first foreign player wey go play for the Albania national football team as e yarn say if e fit get the Albanian passport why not if not.

The post Olayinka fit miss 2nd leg waka against Chelsea for europa League appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Chukwueze Faces Messi Test As Villarreal Tackle Barca At Camp Nou

Philomina Ngozi

The Nigerian Players Hoping To Book A Place In Qatar

Philomina Ngozi

Shehu Relishes Bursaspor’s First League Win Vs Ankaragucu

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy