Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Osun United to gbege 3SC for inside OSOGBO

NNL group B1 Strugglers Osun United go welcome 3SC wey dey form for their matchday kasala for inside the Nigeria National League (NNL) for the Osogbo township stadium,dis  Saturday wey dey come so.

Osun United bin add players wey get experience join the team before season start but things no go well as b4 b4 coachee wey be David Samson Unuanel take plan am the team dey bottom of Group B1 for the 2018/19 NNL season with just one point from 3 games.

The coachee wey pack Im load Waka with  immediate effect tok  say im  players dey purposely lose matches.

 

Unuanel bin resign as the head of technical crew of the club early dis month after im team fall Yakata to  Brillars Giants after dem lose their 2-0 kondo first half lead and the Giants come back to kpokpo dem 4-2 to kolobi the game.

 

Meanwhile their opponent wey be  3SC only for weekend kpokporise Bayelsa United 3-1 and dis one don give the warriors better confido for the team and the belief say dey for beat any team Don dey.

Even with the New confido level wey Don rise so, Supporters and fans  of the Playoffs warriors  Don carry advise give the team say make den be careful against Osun United as dem go use everything wey dey get to kpake  dis  game because of their poor run so far.

3SC dey enter dis derby as table toppers with seven points from three matches,  while United dey  fifth spot with one point from the same number of games.

The post Osun United to gbege 3SC for inside OSOGBO appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

ITTF Nigeria Open 2019 – About 200 Players Set To Storm Lagos

Philomina Ngozi

Erudite Lawyer Eghobamien to ‘Run For Justice’ at Lagos City Marathon 2020

Philomina Ngozi

Aina Relishes Torino Away Draw Vs Milan, Grateful To Fans

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy