Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Our aim na to kpake promotion, says Kogi united skippo

The Skippo of  NNL side Kogi United Musa Stephen yarn say im side work hard to carry ready for the chacha season wey go soon start for the Nigeria National League.

 

E say him and im teammates dey aim dis coming season so na to kpake promotion enter the NPFL and dem don dey work hard to make sure say dem achieve am.

 

E say the Koko dis season na to get promotion wey then carry the team go the highest level wey be to play continental football. According to Musa, since coachee Tunde Abdulrahman don resume, the team dey train and do well and the entire team dey work together to give am the support wey e need to do im work well.

 

Ontop improvement level, the Kogi skippo tok say with the kine supports wey the chairmo and the Governor dey give dem, financially dem no dey do too bad and e go go along way to heleping dem kpake the target wey dem don set for the upcoming season.

The post Our aim na to kpake promotion, says Kogi united skippo appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Everton, West Ham United Chase Aina

Philomina Ngozi

‘We’ll not get Carried Away,’ Rangers Int’l FC Coach Ogunbote Insists

Philomina Ngozi

Berahino, Niyungeko Boast Burundi Are Ready For Nigeria, Other AFCON 2019 Group B Foes

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy