Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Ozil make Turki Presido Erdogan im Best Man as e marry for Istanbul

Arsenal player Mesut Ozil don marry im Fiancee wey be Amine Gulse for Istanbul and na Turkey Presido Erdogan be im Best Man.

The German star wey get Turkish root bin to provoke fans with im legberious waka for the Europa League and now e don cause another wahala with dis latest matter.

 

Fans no happy at all and dem don enter inside social media to tok their mind concerning the presido invitation.

 

Mesut Ozil wey comot hand for the national team sake of tarsis say e take photo with the Turkey  presido bin invite  Recep Tayyip Erdogan and im wife Emine as honorary guests as im marry tey tey girlfriend wey be former  Miss Turkey.

 

Ozil public support for the Turkey presido don affect the course of  im career. Dem born Mesut  for Germany to one Turkish family.The whole gbege start wen Ozil and Ilkay Gündogan, another  German player wey get Turkey blood bin face public anger for May 2018, after dem jam with  Erdogan come give am jersey join .

 

Many people including the German Football Federation (DFB)  and im presido wey be Richard Grindel, claim say dem bin get hand for im  “election campaign stunt”  after photo of the meeting go public.

 

Ozil later come out to deny am say nothing like politics for the picture say na just to demonstrate respect for where im come from.

 

But as e dey so Ozil no send wetin anybody tok by im action for im wedding as e  make sure say Erdogan full ground.

The post Ozil make Turki Presido Erdogan im Best Man as e marry for Istanbul appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Nigeria kick off World Cup against Portugal, who have never lost an Opening Game

Philomina Ngozi

How Super Eagles Players Lined Up In Training Game That Ended 4-1: Musa Hit Brace, Tijani, Onuachu On Target

Philomina Ngozi

Ex Eagles star identifies ‘Best football culture’ Nigeria should emulate

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy