Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Ozil no get leadership qualities cha-cha – Fabregas

After the 4-1  Yakata falling of Arsenal for the Europa League  Final against Chelsea, b4 b4 Gunners midfielder wey be Cesc Fabregas Don para provoke for Gunners German playmaker wey be Mesut Ozil.

Fabu say Ozil no get leadership qualities at all. E say Ozil dey find more quality and big players before e go fit shine.

 

The German playmaker don play together with ogbonge sabi players like Ronaldo, Benzema, Modric, Toni Kris,  Sergio Ramos as club colleagues for Real Madrid.

 

Im waka enter England suppose make am force on im own right but instead na so so struggle e dey struggle and mouth come follow am.

 

Ozil no dey fit dictate how play go be for team and e show am e fail to dictate proceedings for the Europa League final against Chelsea and im team pay for am.

 

If to say the gunners kolobi the Europa League trophy,  den for quality automatically for the Uefa Champions League wey dem don miss for the past two seasons now sake of say den no qualify from the league directly.

 

Fabregas just like others feel say, Ozil na player wey no dey show up for big games.  And now dem Don Dey question the kpogiri wey e dey collect join whether make the gunners sell am,  go buy player wey go deliver for dem.

 

Arsenal never recover from the Final Alhaji nacking for the Europa League.

The post Ozil no get leadership qualities cha-cha – Fabregas appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Nuggets And Nikola Jokic Will Host Lakers At Pepsi Center

Philomina Ngozi

Mubarak Said signs for Niger Tornadoes

Philomina Ngozi

Enyimba extends unbeaten run with a derby win over Rangers

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy