Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Plenty people follow France 2019 opening game

The FIFA women’s world cup don finally start as host France open the 2019 Women’s World Cup  with better 4-0 kondo akpako nacking of South Korea on Friday.

Na Goals from Eugenie Le Sommer, Wendie Renard (2) and Amandine Henry carry the kpake give  the French side and now many dey see dem as one of the favourites to kolobi the tournament.

 

45,261 fans na im witness wetin shele for inside the Parc des Princes and dem no regret as Corinne  Diacre side give dem value for their money.

 

Chance dey say France fit become the second host nation to kolobi the trophy if dem continue to  dey ginger their swagger like dis fo play at this level but the United States, Germany and England go  be hard nuts to crack as their team strong too and dem go provide stiff competition.

 

Dis year tournament  bin represents big step forward for women football. The £24 million wey dem  give to teams wey dey participate na double the amount for the 2015 World Cup. Aproko wey dey  say  na total of 950,000 tickets dem don sell for the tournament so far.

 

Tori say almost 10 million naim follow watch the kasala between France and South Korea and dis one come after France friend friend gbege against China before the World Cup wey draw audience wey reach 1.2 million.Dis one show say the women’s world cup na big tournament.

The post Plenty people follow France 2019 opening game appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Lobi Stars threw away two goals lead and share the spoils with Pillars in Makurdi

Philomina Ngozi

Money move! Super Eagles’ World Cup hero finally dump Leicester

Philomina Ngozi

Cardiff City Join Race To Sign £12m Rated Moses

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy