Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Record hosting interest yakpa for the Rugby World Cup

Tori wey dey says Rugby fans wey dey around the World fit start now begin dey plan their own Olympic waka as the Organizing committee don launch the Tokyo 2020 official ticket website.

The launch come as waka to kolobi spots for the Tokyo 2020 continue with the ogbonge men and women’s HSBC World Rugby Sevens Series 2019 and na top four nations from each set go qualify directly.

Already Japan don get automatic qualification for both the men and women competitions,sake of say na dem be the host but the remaining seven places for each competition, dem go determine am through global process of regional qualifiers and repechage events( dis one mean say the best-placed teams wey failed to win heats go come compete for place for the final).

The Olympic rugby sevens competition go shele for the iconic Tokyo Stadium, wey be the Rugby World Cup 2019 venue, from 27th July go reach 1st  August.

 

Meanwhile, na earlier dis week record number of unions don come out to formally express their interest to carry host the Rugby World Cup Sevens for 2022.

 

Tori say dis record level of interest show say the sevens format na the driving force wey dey behind record rugby fan growth especially among young people dem.

The post Record hosting interest yakpa for the Rugby World Cup appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

NFF Sets Up Special COVID-19 Task Force

Philomina Ngozi

Rangers, Enugu State Govt. Didn’t Abandon Chukwu -GM, Owumi

Philomina Ngozi

Boboye Blames Super Eagles CHAN 2020 Ouster On Bad Officiating

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy