Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Ronaldo say im first season for Juventus na the best

Cristiano Ronaldo don insist say im first season for Juventus na the best of im career.

Ronaldo bin join Juventus from Real Madrid last year summer and e don go ahead to helep im chacha side kolobi the Serie A title and the Supercoppa Italiana before e come waka go kolobi the Nations League glory with im country Portugal.

 

Even though say e don dey old, Ronaldo still dey ginger-like youngi for Juventus and e kolobi 28 goals for 43 games across all competitions, e also provide 10 assists join.

 

For the 2016-17 campaign Ronaldo bin score 42 goals for Real Madrid wey later kolobi La Liga and the Champions League,join the UEFA Super Cup and the Club World Cup.

 

For the 2011-12 e score 60 goals for inside 55 games and kpake La Liga.For 2014-15 e score 61 goals for 54 games for Real across all competitions.

 

Ronaldo also try score 42 goals for Manchester United for the 2007-08 and dem later kpake the Premier League and the Champions League join.

The post Ronaldo say im first season for Juventus na the best appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Fantastic Five – The Top Five Players To Watch In Nigeria U17 Team At The U17 AFCON

Philomina Ngozi

Truth Behind Salah And Klopp’s Alleged Bust-Up Amid Liverpool Exit Claims

Philomina Ngozi

Everton Star Ademola Lookman returns to Nigeria

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy