Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

See as Naija fall anyhow for FIFA ranking

Nigeria don fall yakata three places go 45th position for the latest rankings wey the International Federation of Association Football (Fifa) bin release.

Dis announcement shock many people as the Super Eagles bin move up go four places for the rankings for April.

Super Eagles don play friend friend gbege against Zimbabwe as part of their preparation for the 2019 Africa Cup of Nations (Afcon)but e end for goalless draw for inside Asaba.

The Super Eagles dey among the African teams wey drop very low for the latest rankings, dem join Guinea, DR Congo, Lesotho and Seychelles as the African teams wey get the biggest drop for the standings.

Even with the drop dem still remain the third best team for Africa behind Senegal wey be number one for Africa and 22 for world and Tunisia wey be 2nd for world and 25 for world.

Morocco na 47, DR Congo 49, Ghana 50, Cameroon 51, Egypt 58, Burkina Faso 59 and Mali 62 come make up the other top 10 teams for the continent.

The next Fifa ranking go come out for July 25 and Nigeria go dey hope to improve ontop the rankings with their performance for the Africa Cup of Nations.

Nigeria dey Group B of the tournament with Guinea, Burundi and Madagascar.

The post See as Naija fall anyhow for FIFA ranking appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Zirkzee lifts first Bundesliga title with Bayern Munich

Philomina Ngozi

Adekuroye: Sunday Dare is The New Messiah in Nigerian Sports

Philomina Ngozi

Victor Osimhen set for Serie A switch with Atalanta

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy