Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

United dey eager to keep Pogba for Manchester

Tori say Manchester United ready to give Paul Pogba better contract with plenty kpogiri as dem dey desperate for am to stay old Trafford.

Pogba bin yarn im mind to waka comot dis summer for weekend after e tok say dis fit be the time for chacha challenge.

Already Real Madrid and Juventus don shook eye put for am but United  don make up their mind to keep am next season unless dem get offer for am wey pass the £89million wey dem pay Juve  for am for 2016.

United ready now to keep Pogba so tey dem wan increase im current £290,000-a-week salary to £500,000 wey floppy Alexis Sanchez dey collect. Pogba get two years wey remain ontop im contract and United get the option to extend am by 12 months.

Aproko say Real Madrid don make offer of £90m to take test whether United go sell. Juventus sef wan kolobi Pogba back three years after e waka go England back but dem understand say e prefer Spain.

United chief Ed Woodward no gree make player wey dey bring better market come comot and naim make dem no allow am waka go Barcelona last year.

The post United dey eager to keep Pogba for Manchester appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Ganduje Splashes Cash Gifts On Kano Pillars Players For Aiteo Cup Success

Philomina Ngozi

Indian superhero Mary Kom getting ready for Tokyo olympics

Philomina Ngozi

Sarri: I Prefer Jorginho To Kante

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy