Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

We go use AFCON 2019 as lesson for future tournaments – Kenya’s Ouma

Kenyan defender wey be Eric Ouma yarn say Harambee Stars go dey move forward dey go after the Africa Cup of Nations (Afcon) experience wey dem get.

Harambee Stars bin dey appear for the first time for the finals after 15-years wait and dem fail to make am past the group stages for Egypt after dem finish third for group wey Algeria, top and Senegal come second.

 

Ouma wey dey play for Swedish club Vasalund, insist say the team try their best and go use the experience wey dem gather from Afcon for future assignments.

 

Kenya begin their Afcon with 2-0 kondo yakata falling against Algeria, but dem recover to kpokpo Tanzania 3-2 before Senegal come waya dem 3-0 kondo.

 

As e dey so Harambee Stars don focus their mind go the African Nations Championship (Chan) competition where their home-based players go jam Tanzania for inside two-legged qualifier later for July.

 

The first leg go shele between July 26 and July 28 and the second leg go shele for August 4 for Nairobi.

The post We go use AFCON 2019 as lesson for future tournaments – Kenya’s Ouma appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Mikel Gets All Clear Ahead Gaziantep Clash After MRI Scan

Philomina Ngozi

Guinea Coach Considers Dropping Keita From AFCON 2019 Squad Over Injury

Philomina Ngozi

Croatia’s Vida Apologizes to Russia over Pro-Ukrainian comments

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy