Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

WE NEVER DEY TOK ABOUT WINNING – GYAN

Ghana striker Asamoah Gyan say time never reach to begin dey tok about the black stars kolobing the Africa Cup of Nations (Afcon) trophy for Egypt as dem dey ready to play Tunisia for the Round of 16 on Monday. 

The Black Stars dey prepare to face the Carthage Eagles after dem finish top of Group F after the first round.

 

Black stars play 2-2 draw with Benin,0-0 draw with Cameroon, the four-time champions come beat Guinea-Bissau 2-0 kondo for their last group fixture to take set up gbege with the North Africans.

 

Ghana dey ginger to kpake the Afcon for the first time since 1982 as dem don progress enter the knockout stage for the seventh time in a row – 2008, 2010, 2012, 2013, 2015, 2017 and 2019.

 

Dem reach final for 2010 and 2015 but dem lose give Egypt and Cote d’Ivoire respectively.

The post WE NEVER DEY TOK ABOUT WINNING – GYAN appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Nigeria 1-0 Burundi: Super Eagles Rated and Slated

Philomina Ngozi

Real Madrid Join Osimhen Chase

Philomina Ngozi

Rohr happy Eagles didn’t finish AFCON empty-handed

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy