Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

We ready to ginger well dis season – Abia Angels Coach Chiejine

Na small thing the team take miss Super 4 last season as dem finish third for  Group B. Camping Don start since March and the team Don play many friend friend gbeges with some other teams wey come from Aba.

The team dey use dis games to take try out and blend their players.

The b4 b4 Super Falcons goalkeeper say dem go try correct all the mistakes wey dem bin make last season and try meet the target to play for the Super 4 where the team wey hungry and ginger pass go be the real winners of the Nigeria Women Premier League will.

Onto how the League dey now, She say e totori am the way wey the league don carry improve and she feel say very soon, the league go begin dey attract more interest wella for the women game. And too say sweet am say plenty league goalkeepers dey play for different  National Teams for obodo Naija.

Abia Angels go jam Solo wonder Queens for  Finals of the Abia State Federation Cup this Sunday.

The post We ready to ginger well dis season – Abia Angels Coach Chiejine appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Heartland Confirm Indefinite Suspension Of GM Amid Intrigues, Power Play

Philomina Ngozi

Understanding Why Shehu Abdullahi And Ahmed Musa Are Still Important In The Super Eagles

Philomina Ngozi

WWE: Cena, Triple H To Fight Each Other In Saudi Arabia

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy