Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

See how Man City take Kolobi title for Liverpool hand

Na so so drama full the last day of the English premier league 2018/19 season as Pep Guardiola and Manchester City  retain their title after the 4-1  kpokporisation of Brighton and Hoves Albion.

Pep and im boys no show mercy at all as dem end the season well.

 

Liverpool wey dey follow Man city drag title manage to kpokpo  Wolves 2-0 kondo  but their kpake no dey enough to kolobi the title from City hand as City finish on top 98 points while The reds finish ontop 97 points to take finish Second.

 

Now Liverpool go need to concentrate all their mind now ontop their Champions League gorge against Rivals wey be Tottenham Hotspurs on June 1.

 

Other gbeges wey dem play on the last day of the 2018/19 Epl season na,  Burnley wey fall give Arsenal 3-1 for house, Crystal Palace beat  AFC Bournemouth 5-3.

 

Newcastle no pity Fulham wey don go relegation as dem sama dem better 4-0 kondo akpako.   Leicester and Chelsea no gree for demselves as e end goalless for the King Power Stadium.

 

Manchester United come fall hand for Old Trafford as Cardiff City beat dem 2-0 kondo.

 

Southampton and Huddersfield Town come play 1-1 draw,  Tottenham Hotspurs wey dey go jam Liverpool for Champions League final try but na 2-2 draw dem fit manage Kpake against Everton for their cha-cha Tottenham Stadium while West Ham carry Watford do  ngwongwo with the 4-1 disganganrizatin in front of their fans dem.

 

With all dis results so every team don know the position where dem end season. Now na for Liverpool,  Tottenham Hotspurs,  Chelsea and Arsenal to concentrate on top Champions League final Waka and Europa League finals dem for inside Madrid and Baku remain.

 

Na like dis dem stand as Season end.

Team Name                                P   GD  Pts

1. Manchester City.                    38.  72.   98

2   Liverpool.                                38.   67.  97

3.  Chelsea.                                  38.   24.   72

4   Tottenham Hotspur.              38.   28.   71

5.   Arsenal.                                  38.    22.  70

6.  Manchester United.               38.    11.  66

7.  Wolverhampton Wanderers  38.    1.    57

8.   Everton.                                   38.    8.    54

9.   Leicester City.                        38.     3.    52

10. West Ham United.                38.    -3.   52

11. Watford.                                 38.    -7.   50

12. Crystal Palace.                     38.     -2.   49

13. Newcastle United.               38.     -6.   45

14. AFC Bournemouth.             38.    -14.  45

15. Burnley.                                 38.    -23.  40

16  Southampton.                      38.    -20.  39

17. Brighton & Hove Albion.     38.    -25.  36

18. Cardiff City.                          38.    -35.  34

19. Fulham.                                38.     -47.  26

20. Huddersfield Town.           38.     -54.  16

The post See how Man City take Kolobi title for Liverpool hand appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

England Sim Fantasy: the Starting Elevens for GW 6

Philomina Ngozi

Youth Rugby making waves in Zambia Youth Rugby making waves in Zambia APO Group – Africa-Newsroom: latest news releases related to Africa

Are The Clubs Doing Enough To Help Young Players Rejected By The Football Academies?

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy