Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Casillas don go back training

FC Porto Goalkeeper Iker Casillas don come back for pre-season training for Porto just two months after im suffer heart attack.

The 38-year-old bin suffer wetin oyinbo dey call myocardial infarction for training for May and e come do emergency operation before e come return back house five days later.

 

The b4 b4 Real Madrid skippo bin waka enter Porto training ground on Monday as the Primeira Liga side begin dey prepare for 2019-20.

 

Aproko say Porto players go do some kine medical tests before the full pre-season training program go start proper.

 

Casillas future never still clear even though say e tok say aproko wey dey say im wan retire come take up role on Porto board of directors.

 

The Spaniard don stay the last four years of im career for Portugal and e don kolobi winning one Primeira Liga title.

 

Na for 2015 im 16 year waka for the Santiago Bernabeu end.

The post Casillas don go back training appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Ideye’s goal not enough to save Ariz from defeat at Olympiacos

Philomina Ngozi

Guardiola Backs Ederson After Errors In Man City’s Derby Defeat At Man United

Philomina Ngozi

Chelsea will not listen to offers below £12M for Victor Moses

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy