Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Kubrat Pulev to gbege Joshua

E be like say Kubrat Pulev don confirm say im go jam world heavyweight champion wey be Anthony Joshua for Beskitas Vodafone Arena stadium for inside Istanbul for May.

The Bulgarian bin rank No 1 with the IBF and na him be Joshua mandatory challenger.

Dem don give Joshua go reach the end of dis month to take agree terms with Pulev or else dem go collect the organisation title from im hand.

 

Tori wey dey say dem never sign nothing even though say tori wey dey claim say the fight already na done deal and na one wey even Pulev don use style share ontop im official Facebook page on Thursday.

 

Joshua and Pulev bin suppose meet for Cardiff Principality Stadium back for inside October 2017 but the Bulgarian come comot hand for the fight sake of say e woundjor , na so dem replace am with Carlos Takam.

 

The WBO don also command Joshua officially say make fulfill im WBO mandatory obligations and face Oleksandr Usyk since e don re-kolobi im  titles for im rematch with Andy Ruiz Jnr last month.

The post Kubrat Pulev to gbege Joshua appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Martins Usule’s strike deny MFM second maximum points away from home

Philomina Ngozi

Aribo Guns For 10th Rangers Goal; Okoye Eyes Bundesliga Debut For Dusseldorf

Philomina Ngozi

Osimhen: My Goal Vs Cercle Brugge Pleasing, But Defeat Disappointing

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy