Olympic ’96 Gold Medalist for football and b4.naija international Goalkeeper Dosu Joseph tok say na striking position naim players scare pass for world.
E yarn dis one when e bin answer question concerning which position market dey sell wella pass. Dosu say as e dey for world now, strikers na hot cake and if dem hear say one striker dey for somewhere dey score plenty goals , dem go sharperly go look for am to kolobi am.
According to am e say for all the department for football, e say to get strikers naim hard pass any other position for world of football.
Unto wetin dey make am hard for strikers to score nowadays, e say the technic of the game wey done improve wella follow dey make am difficult for strikers to score.
E say teams wan play ten men behind with goalkeeper making 11. E come encourage the Naija players to begin ginger wella as Naija people dey their back.
The post Dosu Joseph: Na Striking Position hot pass for world now appeared first onCornerstone News Nigeria.