Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Bale no tok say e wan comot

Real Madrid Oga wey be Zinedine Zidane tok say Wales forward wey be Gareth Bale no ever open mouth tok say im wan comot Real Madrid.

Bale wey be 30 bin dey ready to join Jiangsu Suning for summer, but the deal come collapse when Real bin want make  the Chinese club pay transfer money.

Since then, Bale don play seven club games for 2019-20 and e kolobi two goals.Real bin break bank pay then-world record kpogiri wey reach £85.3m to take sign Bale from Tottenham for September 2013.

For im time wey e don spend so far for the Bernabeu, Real don kpake the Champions League four times, the Club World Cup three times, and the Uefa Super Cup three times join the La Liga, the Copa del Rey and the Supercopa de Espana.

Tori wey dey say Bale wey currently get wound don fly enter London to go jam im agent, but Zidane insist say dem just allow am to travel go England.

The post Bale no tok say e wan comot appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Giannis Antetokounmpo’s Bucks Set To Host LeBron’s Lakers At Fiserv Forum

Philomina Ngozi

Italy’s Sports Minister Confirms Serie A To Resume 20 June

Philomina Ngozi

FIFA Beach Soccer W/ Cup: Supersand Eagles Set for Portugal Test

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy