Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Falcons samma Icelandic team UMF Selfoss 6-1 for Friendly

Super Falcons of Nigeria don start well for the Pinatar Arena women football festival as dem carry better akpako samma Icelandic team UMF Selfoss 6-1 for the pre-women World cup friend friend gbege for inside Spain.

The  Nigerian girls no waste time at all as Uchenna Kanu (1goal) Courtney Dike(3goals) and Iniumotong (2) register their names ontop scorer sheet to give Naija better comfortable win over the team wey come from Iceland.

Thomas Dennerby and im team go continue their waka for the Pinatar Arena women football festival with their next kasala against Canada on Monday wey be April 5th   and hope say dem go kolobi win against a side wey dey go France with dem.

The Super falcons dey the same group with Host France , Norway and South Korea for World cup group A  and dem go dey pray make all dis friend friend gbeges wey dem dey play so  helep dem go far. Their first kasala for World cup na against Norway.

The post Falcons samma Icelandic team UMF Selfoss 6-1 for Friendly appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

My last Chelsea memory will be last season’s FA Cup final’- Gary Cahill

Philomina Ngozi

Thulani Serero returns to Bafana Bafana squad for Nigeria clash

Omojesu vows to lift Sunshine Stars

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy