Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Glory Ogbona target better dis season, come encourage Super Falcons join

Ibom Angels and Naija Falcons player and before before U 20 Women National team player wey be Glory Ogbonna  yarn say im team dey prepare wella for the new season and say the team get new mentality now.

Acccording to her the team try last season and dis sesaon dem no want miss any opportunity again. She say dis season the team get two targets, one na the Aiteo cup and secondly na the league dem focus ontop.

 

Ogbonna say as the chacha season dey come so for the NWPL, e go good if improvement dey for the area of officiating, e say na the area wey she feel say if dem fit correct the i must win for home syndrome, naija womens league go make sense. She say na high time Naija league get free and fair officiating.

 

Only for weekend Ibom Angels kpokpo Abia Angels for friend friend kasala wey end 2-1 in favor of Ibom Angels and Glory Ogbonna make sure say she register her name for the scorers sheet.

 

As e take concern national team wey be the Super Falcons, Glory say all dis friend friend gbege wey the ladies dey play dey totori am as e go helep expose some areas wey need work and  as we continue to prepare for World Cup.

 

She encourage the gals to go out there, show qualities and represent Naija wella.

The post Glory Ogbona target better dis season, come encourage Super Falcons join appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Championship: Eze Scores, Grabs Two Assists In QPR’s Win Vs Cardiff; Etebo Absent Again For Stoke

Philomina Ngozi

Usain Bolt nets brace in first match for Central Coast Mariners

Cameroon 2-4 Nigeria: Super Falcons through to AWCON Finals

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy