Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

I like Dortmund Pass Man U – Haaland

Erling Haaland don come out to carry explain wetin make am decide for im mind to chose Borussia Dortmund instead of Manchester United for January, as e reject claims say im bin dey ask for big kpogiri salary when dem bin dey negotiate.

Everybody bin think say na United be the favourites to kolobi the b4 b4  RB Salzburg striker, even sef Ole Gunnar Solskjaer get plenty confido say im go fit convince the teenager wey e last link up with when e still be Molde manager.

 

But as  e  dey so the 19-year-old binmake up im mind comot United for setting come waka go join Lucien Favre side for inside move wey reach £17m .

 

 

Tori bin dey suggest say the Norwegian don put mind to kolect £6.65m salary – £128,000 per week – but Haaland tok say no be so.

The post I like Dortmund Pass Man U – Haaland appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Oshonaike Hints At Coaching After Retirement 

Philomina Ngozi

Liverpool Goals: Top Ten of the Season 18-19 (Video)

Philomina Ngozi

Brazilian club Botafogo in talks to sign Mikel Obi

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy