Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

I suffer Racism wella for Italy – Taribo West

With all the Racism Kasala wey don yakpa dey happen for World of football so,  b4 b4 Naija international wey be Taribo West don open mouth yarn say no be today e don dey happen,  say wen e dey playback in the days e even worse pass today.

E say at least now players get people wey dey help dem fight this gbege wey wan spoil football but back then,  nobody dey fight for black players.

 

As e dey now black players for world  don unite say dis racism thing dem must to find solutions, some organization’s sef don enter the matter and the World governing join bodies like FIFA,  UEFA etc don join the fight so that everybody no matter your Color, Race, Religion or even sexual preference go enjoy the game.

 

E never too tey wey some England black players like Callum Hudson Odoi, Danny Rose and Raheem  Sterling suffer am.

 

Dele Alli,  Pierre Emerick  Aubameyang, kalidou Koulibaly, Troy Deeney, Mario Balotelli, Kevin Prince Boateng,  Mesut Ozil, and many more don be Victims of racist abuse dem.

 

Even Many Naija players for different leagues for world don experience am at one point or another.

 

Taribo come yarn how him  too  take suffer the same thing wen e bin dey play ball for Italy. E say racism don even reduce now pass b4 when Im bin dey play.

 

E say where e bad reach,  the only place wey Im dey go wey dem no dey racially abuse am no wen im team play for their home ground wey be San Siro,  e say apart from that na everywhere wey im  play for Italy im dey suffer am.

 

According to West,  e say Racism yakpa for Germany followed by Italy, then England and other places but e say e no too dey for France.

 

Racism dey come in different forms,  some na through social media , some for field of play,  even players dey racially abuse their opponents, some na from wetin dem write or too and so on.

The post I suffer Racism wella for Italy – Taribo West appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Rohr: AFCON Spots Still Up For Grabs In Super Eagles

Philomina Ngozi

Gerard Piqué Quits Spanish National Team

Philomina Ngozi

BREAKING: Gunmen Abduct ex-Super Eagles coach Samson Siasia’s mother in Bayelsa state

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy