Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Kenya go surprise people for Egypt 2019

As the draws for the Afcon 2019 don come and go so, many ex-internationals and presidos of football federations still dey yarn concerning the possible chances of some teams to shock others for the tournament wey go start for June. 

One of such people wey tok na  b4 b4 Senegal star wey be  El Hadji Diouf wey believe say Kenya na one team wey go cause problems for the 2019 African Cup of Nations (AFCON) for inside  Egypt. E insist say the Harambee Stars na hard nut to crack and say dem don improve wella over time .

 

Stars dey the same group with he b4 b4 Liverpool star country wey be Senegal for Group C of the June 21-July 19 showpiece together with Algeria and Tanzania.

 

Diouf tok say the group dey tough. E say Kenya Match against Ghana bin open their eyes to know say dey go be difficult side for Senegal and for the group. According to am e say Kenya dey play good football.

 

 E Dey expect either Kenya or Tanzania to make am reach the knockout rounds especially as Car don make room for four best third placed teams to  progress with did one wey dem expand the  tournament .

 

Diouf bin dey Cairo for the tournament draw and from there Waka enter Tanzania for the CAF Under-17 African Cup of Nations wey dey shele now.

The post Kenya go surprise people for Egypt 2019 appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Former Egypt star Abdelghani tips Pharaohs to host and win 2019 AFCON

Osimhen tipped to wear Tottenham’s famous number 9 shirt

Philomina Ngozi

Lobi Stars stroll past Kwara United in Makurdi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy