Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

More wahala for Neymar as Uefa nack am akpako ban

Tori say Uefa don carry three Champions League matches akpako ban samma Neymar sake of the way e carry behave after Paris Saint-Germain yakata falling to Manchester United last season.

The Brazilian bin watch the second-leg kasala from the stands for the Parc des Princes but later enter Social media dey para as e see im side crash comot sake of Marcus Rashford penalty wey come for stoppage time.

 

E yarn anyhow after VAR award the penarity give Manchester United for their last-16 tie for March.

 

Meanwhile Neymar don tell Paris Saint-Germain presido Nasser Al-Khelaifi say im wan comot the club and say im for no comot from Barcelona.

 

Na for 2017 the Brazilian bin waka comot Barcelona enter Paris for world-record kpogiri wey reach £198million.

 

Tori say PSG oga wey be Thomas Tuchel sef don tire for all the katakata wey Neymar dey create for inside dressing room and e no even send am if e wan waka.

The post More wahala for Neymar as Uefa nack am akpako ban appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Lagos Man Utd Fans Hit Back At Arsenal With Coca-Cola Sponsored Replays

Philomina Ngozi

2019 AFCON: Rohr Predicts Tough Draw For Super Eagles

Philomina Ngozi

Listed: Players Expected To Join, Leave And Stay At Man Utd This Summer

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy