Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

My boys play wella against Morocco- Ricardo Mannetti

After Morocco manage kpokpo Namibia 1-0.kondo on Sunday for the Africa Cup of Nations group kasala,  their coachee wey be Herve Renard  don salute Namibia sake of the way wey the players carry ginger against im boys. 

The Atlas Lions bin open their 2019Group D kasala with narrow 1-0 kondo kolobi over the Brave Warriors for the Al Salam Stadium for inside Cairo.

 

The gbege for even end kondo kondo draw soup if no be the own goal wey Namibian Itamunua Keimunine score to carry  give Morocco bragging rights for the 89th minute, after Im try clear ball wey come from the free-kick wey Hakim Ziyech bin play.

 

Already many see the Atlas Lions as one of the tournament favourites and now the two time winners go jam their coachee b4 b4 team and 2015 Afcon winners wey be Ivory Coast  for the Al Salam Stadium on Friday.

 

Meanwhile, Namibia head coachila Ricardo Mannetti say im boys totori am with the way den carry play Morocco wey get plenty ogbongelicious players dem and for im mind e feel say dey suppose at least draw the game.

 

Dis Afcon go mark Namibia comeback to Africa’s biggest football tournament their return after 11-year absence. Namibia go now face South Africa for  their second Group D Kasala wey go also shele for the Al Salam Stadium on Friday.

The post My boys play wella against Morocco- Ricardo Mannetti appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

LMC slams Wikki Tourist with N5m fine for breaches of NPFL Rules

Philomina Ngozi

Mikel Agu predicts bright future for Super Eagles

Philomina Ngozi

Novak, Nadal and Federer to sidon tok

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy