Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Naija Referees too dey fear – Elahor

B4 b4 Super Eagles Eagles Midfielder Friday Elahor don come out to yarn concerning The NPFL and dis beating beating of Referees. 

 

E say no be today dis one don start especially if e concern home game and e say we don mature pass to dey do dis kine thing, say time don reach for people to begin dey respect the law of football.

According to Friday “if teams wey dey house prepare wella , no team go come ya house come beat you”. Instead of teams to ginger for house, na refs go come suffer am and na wrong thinking be that.

 

The sabi Midfielder come make reference to one kasala wey shele one time between two Naija Npfl teams where referee carry matvh enter 110 mins sake of say referee dey fear, e say dis kine thing no make sense at all.

 

Oga Friday come add join say referees too dey fear and naim follow dey affect us for international level where naija refs dey make FIFA or CAF competitions.

Elahor say him no really blame the referees dem , say naija attitide bad but e say dis small small ones wey dey come up now dey try but na time go tell how far dem go go.

The post Naija Referees too dey fear – Elahor appeared first on Latest Sports News In Nigeria.

Related posts

Ronald Relishes Football Winnings at 35: ‘I Thought I Was Going to be a Fisherman’

Philomina Ngozi

Etebo bags first career red card in Stoke city win

Sand Eagles can survive World Cup group – Abu Azeez

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy