Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

NNL don shift date again by one week

Aproko wey dey say the 2018/2019 Nigeria National League, wey be the NNLno go start again on Wednesday wey be the 3rd of April,2019 as dem take plan am. 

Tori say the league go now start on Wednesday wey be the 10 of April 2019 while dem go now hold chacha draws on Friday 5 th of April 2019 for inside  Abuja.

Dem don invite all the clubs dem to come witness this latest draw wey dey very crucial and wey go see the earlier four(4) abridged division expand go eight (8).

 

This one dey sequel to the decision wey the Nigeria Football Federation, NFF, Football Committee take to  now extend the groupings from 4 go reach 8 for the season,after dem shook eye check wetin dey happen for  the NNL to make sure e go  with the domestic football calendar from the NFF,the African soccer governing body -CAF and that of the World governing join body wey be FIFA.

 

The chacha draws go shele for the  Jabi  area of Abuja and go start by 6PM,to take determine the chacha eight groupings.

The post NNL don shift date again by one week appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Omeruo Plays Down Injury Scare Ahead AFCON 2019

Philomina Ngozi

Musa, Awaziem, Ighalo on target as Eagles beat Seychelles 3-0

Pulis: Mikel Has Proved Doubters Wrong

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy