Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Real don send Odegaard ontop another loan waka

Real Madrid don send smallie Martin Odegaard out ontop loan waka again go Real Sociedad for the 2019-20 season. 

The Spanish giants don confirm the news and dis one go be Odegaard third loan waka for Madrid since im waka come the club for 2015.

Since im move four years ago, Odegaard don go loan waka for Heerenveen, before e come spend small time for fellow Dutch side Vitesse. Odegaard bin join the Spanish giants as one of the hottest talents wey dey the world football and many bin dey expect am to blow but e no gree blow.

Na only two times e don play for Madrid first-team since e move come Spain from Norwegian club Stromsgodset.

E bin shine wella when e bin dey ontop loan waka for Vitesse last season, as e score 11 goals come create 12 assists, and e go dey hope to show Real wetin dem dey miss when e go shine for  in La Liga with Real Sociedad.  

The post Real don send Odegaard ontop another loan waka appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Super Eagles Training – Maduka Okoye Shines In Shooting Drills Against Ezenwa

Philomina Ngozi

Rangers Forward Ojo Ready To Dump England For Nigeria

Philomina Ngozi

Pulisic Joins Chelsea In £57.6m Move From Borussia Dortmund

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy