Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

U17 AFCON – Eaglets fall hand

Naija Golden Eaglets don fall yakata after the Junior Sylis of Guinea comot dem for setting through penarity and now dem go play Angola again for third place finish while Guinea go jam Cameroon wey also kpokpo Angola ontop 4-3 penarity waka to make the final.

Guinea U17 kpokpo Nigeria U17 10-9 ontop penarity for the first semi-final clash for the National Stadium, Dar es Saleem.After the match end 0-0 after 90 minutes,ref no add any extra time and dem go straight to shoot-out where Ogaga Oduko come miss the kick wey comot the Golden Eaglets for setting.

 

Na the Guineans bin dominate early for the game and dem make sure say dem pressure naija till 90 minutes  before dem play penarity to take decide who go enter Final.

 

Nigeria bin get late chances to kolobi the game,even Alfred Olaniyan come close for injury time, but the Guineans no gree at all. Dis one show say the Eaglets no take their chances at all and e come cost dem.

 

The Eaglets go now play the loser finals against Angola for the third and fourth place play-off.

The post U17 AFCON – Eaglets fall hand appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

International Monetary Fund (IMF) Executive Board completes Tenth Review under the Extended Credit Facility Arrangement for Mali and approves US$43.85 Million Disbursement APO Group – Africa-Newsroom: latest news releases related to Africa

Nigeria Amputee Football Federation Boss Laments Lack Of Support For Special Eagles

Philomina Ngozi

Onuachu One Goal Away From Matching Genk Goal Record For A Season, Nets Goal Number 29

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy