Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

We go always dey there for we ex-internationals dem – Pinnick

Presido of the Nigeria Football Federation, Mr. Amaju Melvin Pinnick tok  say the football governing join  body go soon institute  welfare foundation for before before Naija international players dem to take make sure say kpogiri dey on ground for them in case of unexpected health challenges as e take happen n with Chairmo  Christian Chukwu.

 

Na both the NFF presido and  the 1st Vice Presido of the Confederation of African Football, give dis assurance for inside  London.

 

For the NFF Football Awards for  Lagos on 1st April 2019 naim dem announce say dem go form welfare foundation for we football legends dem to take care of them wen dem dey in time of need.

As at the time wey dem yarn dis one dem no even think am say Chairman Chukwu go get dis kine health challenge.

But Presido Amaju say im happy say  dem bin fit  make better arrangee for im surgery, medication and general after-surgery care and  say by the time e go come back naija,  e go dey  hale, hearty and sound of mind and body.

The post We go always dey there for we ex-internationals dem – Pinnick appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Villarreal Boss Emery tasks Chukwueze on Goal scoring

Philomina Ngozi

Success Future Remains Uncertain As Window Nears Close

Philomina Ngozi

France 2019: FIFA Approves VAR For Women’s World Cup

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy