Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

AFCON 2019: Delort don replace Belkebla for Algeria squad

Algeria don call Montpellier striker Andy Delort to take replace Haris Belkebla wey Coach Djamel Belmadi bin drop sake of say e misbehave.

Na on Tuesday, video footage of Belmadi bin appear ontop social media where im dey expose im backside.

 

After the video surface, na so coach Djamel Belmadi come vex provoke drop Brest midfielder from im squad wey dey ready for the 2019 Africa Cup of Nations.

 

Delort don play before for France U21 and now the 43 year old coach Djamel don give m chance to play for the Desert Foxes for Egypt.

 

Delort bin dey better form for French Ligue 1 side Montpellier last season as e kolobi 14 goals for 36 league appearances wey e make to take helep im side finish the season ontop sixth position for table.

 

The Desert Foxes dey the same Group C with Kenya, Senegal and Tanzania and dem go begin their Afcon 2019 waka against the Harambee Stars on June 23.

The post AFCON 2019: Delort don replace Belkebla for Algeria squad appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Ighalo, Osimhen, Chukwueze and Oshoala represents Nigeria in final shortlist for CAF Awards

Philomina Ngozi

Besiktas Line Up Move For Lookman

Philomina Ngozi

Falcons assistant coach Madu expresses team’s delight after waiting period tension

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy